Impact Sports Media

Impact Sports Media

Home of football

14/01/2022

Stage Age

Hottie Hottie, na your matter dem dey talk for town
Any babe wey no dress reach you for town na clown
You dey pepper dem with your designers
Even your face makeover na designer

Your backside dey make men backslide
None of the guys can see those baloons and just slide
Dey no fit watch those twerk videos make dem no DM
Market dey move, one new message from the PM

Well, I just say make I remind you say this time shall pass
No be everybody wey carry expo dey pass
Like wall of Jericho, your assests and crowd go fall
Even the prices of your expensive designers go fall

You go use kayamanta e no go work
Your asset go be value wey you gain when you fit work
My sister, those your followers no go follow you enter this age
Audience go comot, e go remain you for stage.

Written by:
IMPACT

Telephone

Website