Eshockucommunitymata
We say make we dey discuss the ballot box development to bring development come all we community.
We D People, I troway salute, we say make we kontiniu our ballot box and community development mata.. the off circle governorship election just finish for some of the state for Nigeria and we D PEOPLE say make we still remind all of this our governor wey win and all other officials wey we elect before before say all we dey ask na for them to provide the people with good governance wey be the provision of basic amenities for all we communities; that is give us ballot box development as ballot box and paper take enter or reach every area for the communities...
We D People, thank you for the folo wey una dey folo us and for all the comment wey we dey receive, no forget say na becos say make u and me use our voice bring the ballot development reach all our community on top say ballot box and ballot paper reach everywhere nai make us come start dis our community mata. So we go continue the ballot development episode until you and me start to dey see d change wey we want, the good governance wey we want, the basic amenities for beta life wey e nor dey hard to give again we wey want.
Nai make we come say thank you to Hon Ekene Adams of Chikun Kajuru Constituency for Kaduna State for the ballot development wey him start to do for e constituency, dat is Hon.Ekene Adams come decide to go give back to e people and donate wetin him know say d community need well well especially the 10 500 KVA transformer to supply electricity for we d people wey no get since na electricity be city and for the 66 women wey him empower with that 150 thousand naira, this mata sweet my belle ful well well nai make we say make we tell Honorable say u do well o, make u continue to empower d people and make our other elected officials folo your example.
We also dey ask women to reject any attempt to use wrapper piece of cloth wey any elected official carry come say na empowerment.. We D People reject wrapper piece of cloth empowerment.
We also dey ask say make all of us continue to dey do d active citizenship especially wen our constitution empower us.
So listen to this our episode 6 on top our ballot development series and no forget to send pictures and video of how the mata dey play for your community make all of us dey use our voice bring d change we dey find.
Until another mata wey go dey arise for episode7, WE D PEOPLE, your country sister troway salute. Una do well.
We D People, your kontry sister troway salute and say thank u to everybody wey dey join us for dis we corner. No forget say u fit join us for all d social media handle wey dey sofili dey waka pass as u dey watch d video so.
So thank you again We D People.
And if you dey folo us since wey we start this our community program, u go see am say na d ballot box development nai we dey continiu to hammer on as we say make all of us use our voice take bring change come we community wey development nor dey upon say ballot box and ballot paper reach there.
But Today we as citizens as constitution take empower us wan do Citizen's check and folo up on d boat wahala wey claim almost 106 people live for Ebu community for Kwara State.
So welcome again to our community mata program.. and then watch the video make all of us put mouth for the matter as citizens of our great country to make sure say we folo d mata to infinity until EBU community get at least better ROAD wey government suppose to provide to that community to give them access to other community. This na the work of gworment and this na the reason we go queue up to vote for them dat day. Gworment abeg construct road for we the people.
SILENCE NOR BE GOLDEN ANYMORE oooo
Grassroot concentration (D Role of Your Councilor)
We d people I troway salute, thank you very much for all your support as we dey move our community to the very permanent site small small, no forget say you fit follow us for all the social media handle. As we dey continue for this our ballot box and ballot paper community development, we come reason am say nothing go be like when all of us for our communities from the grass root go like to tanda inside the matter wey concern our community. And one of those matter wey suppose to concern us na how our councilor for our ward take dey work, we go ask our selves weder we know the role wey our councilor dey play, we dey see them? them dey stay among us, becos we nor elect them make dem go dey stay city, na for them to dey deir ward make them dey know wetin dey happen for we community and then advocate for the community base on the amenities and good governance wey the community need nai make us vote for them.
So going forward as I don ask you so try to ask yourself weder you know your councilor for your community or your ward, na the role of that councilor nai we discuss for this our episode 3. Abeg watch the video and then let us know where you for dey reach us from and tell us weder the councilor of your ward even know why him be councilor before him go even know say him go advocate to bring good governance to the people wey vote am into office.
As we dey progress for this our ballot development, we say if ballot box and paper reach the whole community for we kontry, then development suppose still reach there, nai be the purpose of this our program. In order words if you get wetin dey shock u for your community na you go write come WE D PEOPLE ESHOCK U COMMUNITY MATA say see wetin dey happen o then we go begin to talk am to draw attention of the people wey suppose do wetin dem suppose do to hear. All na to make sure say the good governance wey we dey find reach all of we community.
Thank you again for following us, we go bring another episode come again. Until then
WE D People...
My Kontry people I troway salute, as we continue our discussion for this our ballot box development episode 2, we say make we discuss how our emergency response unit number, that is the emergency unit number for our kontry wey dem say na 112 or 119 take dey work.
Base on some mata wey still happen on our election day, we say make the people wey dey in charge start to orientate us on how we d people go take dey make use of the emergency unit number going forward. We d people wan know wether na national number like 911 wey every citizen fit call when we need help, so that even before the family members of the person wey need help go come, e go be say people wey dey around go don first call our own 112 or 119 to first come help the person wey need help or medical attention since d people go don first get orientation about how to use the emergency number.
As I talk for the video say maybe Mr. Owie wife for no just pass like that if to say the people wey dey around when d incidence happen know say them suppose to call for emergency help before the family member go come.
THE LIVE OF EVERYONE CITIZEN MATAS.
So, people make we dey discuss this our ballot box development mata dey go to bring the desired change all of us dey seek. E suppose to be say as God take bless our great country 9ja, wen citizen need help or dey any danger weder dem dey inside village or Abuja dem suppose fit get help as citizen of our great country 9ja.
So listen to every thing your country sister talk, make we dey kontiniu to dey hammer am until we see the desired change.
No forget to subscribe to our utube channnel, visit our website www.eshockucommunitymata.com, send us wetin dey shock you for your area your community to our whatsapp number wey be +2348105537633, follow us for our twitter handle , our instagram and facebook for more tory as we dey bring as e just be.
People I troway salute.. this na our episode1 for dis our ballot box development mata.. We say if ballot box find deir level reach all the 176 plus polling unit for we kontry den ballot box development suppose reach am for there too.. so join us make all of us use our voice take bring change come our communities. I troway salute, no forget to send us pictures and videos of how your community be to our number wey u dey see so, also follow us for all our handle.. WE D PEOPLE.. I troway salute.
www.eshockucommunitymata.com
Let us know how e dey play for ur community, ballot paper reach dere? Cos if e reach, good road suppose reach dere too..
Ballot paper and ballot box development.... - ESHOCKUCOMMUNITYMATA We d people , I troway salute oh, we thank God say our election don come and the major part of the whole mata don use style finish, except for some kai tory wey we d people dey hear from different corner concerning as the mata take play out. We hope say d people we […]
We d people
E be like say the son of a nobody don dey become somebody... - ESHOCKUCOMMUNITYMATA According to our sister Aisha Yesufu, say she dey look forward to when the son of a nobody go come dey become somebody without knowing anybody for we kontry, as e be say the kontry na for all we d people. E be like say d mata don play out as E shock u community […]
This na E shock U community mata, if something shock u, nor be people u go call ? so if e shock u say water no dey your community, oya halla d e eshock u community D PEOPLE, and we go show gidigba.. All na d ballot paper development.. And d number to halla us or send us d mata wey dey shock u for ur community na 08105537633...
D development must happen everywhere.. As e be so, all of us citizens nah polling Agent.. So over to you begin report d beta tin wey nor dey ur community..
So from now we go start to talk about ballot paper development..if ballot paper fit reach dat village wey light no dey, water no dey, road sef no kuku dey yet ballot box and paper reach there, then development suppose reach there..
Development suppose there o my people
We d people...nor be small shuntin
E SHOCK U..